Submit your work, meet writers and drop the ads. Become a member
Jun 2022
(in naija broken english aka pigin)

in these varying decision times
i just dey on a low
nor be say the matter tire me
i suggest say, i just dey distracted.
as Roe dey fight Wade
conje dey para for me.
omo, na next from one babe then unto another
na ee be the motive,
sadly this lifestyle na everything but
extravagantly ****.
as dem dey pursue Trudeau
na so i dey chase down my destiny,
na when i go take mind re-write
this exam wen dey in front of me?
for naija, election matter dey make man japa
my timeline say na Peter Obi go be their papa,
funny enough i get this feeling say
we dun dey reach the moment wen things go better,
like say this summer na "turn around season".
the true be say, either politics or breakfast
las las everybody dey fight somethin.
the true be say if you dey para, you go have to rise above it.
the true be say, na only God get remedy.

e dun pass time when we go dey look persin for face
e dun reach time when we must to carry matter for head.
this one nor be joke o, but na wake up call
FlipThePoet
Written by
FlipThePoet  26/M/Toronto
(26/M/Toronto)   
141
 
Please log in to view and add comments on poems