Submit your work, meet writers and drop the ads. Become a member
May 2020
Dem say we no go blow
With the line of thought wey we dey tow
Where dem dey when water we dey flow?
Come enter Coconut on the low

Sometimes alarm dey tear
But my brother, make you no fear
If you believe and throway every despair
"Oluwa" go turn your hussle to flair

You fit dey push barrow or do barber today
People go soon gather to celebrate you one day
If it no be like a weekday
But na sure bet say na someday

We fit no look like am today
Dangote start with sweet for him day
Don Jazzy do security for the way
And all of dem don blow today

Kpomkpi, las las we go dey alright
Just make sure say you hussle right
One day you sef go blow enter flight
Come join the billionaires dey alright

But when you don reach your prime
No forget say you too first do the time
Before everything come start to rhyme
Make you show love to your goons for flexitime
Na by like that you go take sustain am for lifetime
Written by
Babatunde Raimi
59
 
Please log in to view and add comments on poems