Submit your work, meet writers and drop the ads. Become a member

Members

Felicia Pemberton
New York    |power to the local dreamer| I love to write! (although I dunno if I'm very good at it) I like meeting new people, so don't ...
ryan pemberton
Canberra   
Opemipo
United State    I love writing, cooking jovial and very studios !

Poems

don adcock  Oct 2013
Poem
don adcock Oct 2013
This [pem suks
U du 2
That wAS LAME
qUIT LOOKING at me
I wi;; kick your ***
Or maybe kiss you
Softly
Babatunde Raimi Sep 2019
A Poem: Bros., Wey You?*

Bros., Wey you?
I hear say your game tight
I wan hear your market
You no need to drop shekels
I just wan help you

Come make me reason
No cone form Asari for me
I no be Orpkorpise oh
Na lashing things oh
You know now!

Abeg make you do pem oh
Na white sky I go take come
Make your name dey your neck oh
Preye say you Gallant dia
Oya, make we enter yonder

Make you walensh well oh
Dem no dey use shame drink poison
I see you, I see heaven
After every don kpomkpi
Las las, we go dey alright

No worry, wetin be suya
If I want make my mouth dey busy
I go just dey blow whistle
So you no go provoke
Know say Lasgidi Erema no fit

When I finish with you
You go know say devil na area boy
Na God be Godfather
Kpata kpata na draw
Warri Erema no dey carry last

I go soon bracket you for Effurun junction
Before omuta go enter
No time to check time
This motor dey delay my destiny
I don dey reach your crib

My temper dey rise now
And I no fit use am boil rice
Afterall, no vero for maternity ward
When I work you finish
You go hear alaba

Today, he no get as he be
I go run your matter wella
I know say you go make sense
Abeg, wuna gi mi cold shack for di side
Nothing dey happen

Babatunde Raimi (c)
Author/Life Coach/Poet