We dey inside moto park for Naija Dey mussle our way, Dey hussle, Dey para, Dey pussle Di way our politician dem Dey take us play ping pong.
After hussle, We go go chill, We go go shake bodi, We go go shayo.
Wetin bi dis one Wey bi say We no go hear something again?
Everywhere now Na Pennsylvania bi di talk. Everywhere now Na Trump talk say for Pennsylvania, Na Kamala talk say for Pennsylvania, Na wetin!? Pennsylvania dey for America, Here na Naija, Wetin concern us for Pennsylvania?
We no dey live for America, We dey live for Naija. Make our government give us Wetin we go take survive for Naija, Wetin concern us for Pennsylvania? Nothing concern us for Pennsylvania.
Chidi Anthony Opara's Nigerian pidgin English language poetry