Submit your work, meet writers and drop the ads. Become a member
Aug 28
By Folorunsho Obalugemo

Leaders wey for high energy
cost and constant darkness
leave people for collapsing grid
run go mount solar for dem palace

Leaders wey dey go come
inside plane and chopper
for bad roads and robbers
plus bandits tell us to endure

Leaders wey dey say my people
tighten una belt well well
get *** béllè up dem baggy
in yeye rolling saggy saggy

Leaders wey dey say it takes
time before enjoyment dey land
dey lavish life like bees
in the face of poverty and pain

Leaders wey small matter
dey take dem to Oyinbo hospital
leave dem people in dire state
until dem land for mortuary

Leaders wey dem own pikin
dey read book for overseas
care little about us, even if
millions no go school

Leaders wey commot subsidy
dey borrow loan, increase fees
exchanging eyesight with stick
leveling big taxes day by day

©August 2025
Folorunsho Obalugemo
Written by
Folorunsho Obalugemo  M/Nigeria
(M/Nigeria)   
64
 
Please log in to view and add comments on poems