Hello Poetry
Submit your work and get some sparkles! Create free account
We dey inside moto park for Naija Dey mussle our way, Dey hussle, Dey para, Dey pussle Di way our politician dem Dey take us play ping pong. After hussle, We go go chill, We go go shake bodi, We go go shayo. Wetin bi dis one Wey bi say We no go hear something again? Everywhere now Na Pennsylvania bi di talk. Everywhere now Na Trump talk say for Pennsylvania, Na Kamala talk say for Pennsylvania, Na wetin!? Pennsylvania dey for America, Here na Naija, Wetin concern us for Pennsylvania? We no dey live for America, We dey live for Naija. Make our government give us Wetin we go take survive for Naija, Wetin concern us for Pennsylvania? Nothing concern us for Pennsylvania.
0
Sep 17, 2025
Sep 17, 2025 at 7:53 PM UTC
Wetin Concern Us For Pennsylvania(Poem In Nigerian Pidgin English Language)By Chidi Anthony Opara
We dey inside moto park for Naija Dey mussle our way, Dey hussle, Dey para, Dey pussle Di way our politician dem Dey take us play ping pong. After hussle, We go go chill, We go go shake bodi, We go go shayo. Wetin bi dis one Wey bi say We no go hear something again? Everywhere now Na Pennsylvania bi di talk. Everywhere now Na Trump talk say for Pennsylvania, Na Kamala talk say for Pennsylvania, Na wetin!? Pennsylvania dey for America, Here na Naija, Wetin concern us for Pennsylvania? We no dey live for America, We dey live for Naija. Make our government give us Wetin we go take survive for Naija, Wetin concern us for Pennsylvania? Nothing concern us for Pennsylvania.
Chidi Anthony Opara's Nigerian pidgin English language poetry
Written by
19/M/Nigeria
Sep 17, 2025
Sep 17, 2025 at 7:53 PM UTC
Request permission to use this poem